My country people e don happen again o. Ona go ask me say na where e happen. Na for Faculty of Law LLT and Faculty of Science FLT na im d matter shelle. The matter na on top GES104(Science and Mankind) test wey join them together . All the students don read them GES test book like person wey wan get 8.0, the one wey fit crame don crame, the one wey no read too dey join body enter the place. Everybody pack themselves go their different centre like normal. As dem reach there, dem wait for test but e no gri come na lecture dem still dey do. All the runaway students too come class. Na im everywhere come full like tin of sardine. Maintenance no gri maintain their light, everywhere hot like UI bakery. Na so people come dey find their way comot inside the place. As dey say make dem dey go, na so GES tutors carry test come o, I trust my ever wise UItes, na so dem turn am to group work, write wetin dem go write comot. The remaining people wey dey Law LLT, their own test too no gree come, na im everybody carry im kaya dey go (as you know now, ‘the struggle continues’ for U.I here). As e be like say everybody go don dey reach where dem dey go, na so people begin dey call dem say “Oga, lecturer don carry test come o”. come see relay race for front of Idia, all those babes wey dey form tush carry their tushness put for hall, na so dem correct cab men come become celeb, guys begin marathon race. As dem get inside Law LLT now, light still no come dey to see for around past 7pm o, but oga lecturer still say dem go write the test like that. Before you go say ‘Jack Robinson’, na so our one and only SU President ‘Ah Speaker’ come inside greet oga lecturers, hail UItes come talk say TEST NO GO HOLD BECOS LIGHT NO DEY. My people, na how the test no hold for dat place be that o. I don do wetin una send me. I won go crash for one place till further notice.