IDIA GIST

IDIA GIST
Longest tym ma people. Hope say una neva vex say e don tey wey we bring una Idia gist. As people go talk am for Naija, na condition make crafish bend. Make una no vex o. E don tey small wey we begin dis semester and plenty tori don come and go, wey I sure say una go don hear sotey una don tire for dem. Many many examples dey like d light palava, we no get light, water no dey, even sef people talk say e be like say strike fit happen sef. We just dey see Idia babes carry buckets dey go Indy or as far as Zik to go fetch water. Hmmmm…….wonders sha no go eva end.
I sure say no be everybody wey too like the change for the entrance to the hall. We don get second gate now wey dey make life difficult small small for Idiates, especially B and C Blockites and Flat occupants. People wey new no go too feel am since demneva used to am before. Also A Blockites no go mind am much since d gate close to dem block.
I come dey wonder say, shey na the change for gate entrance make Idia 101 dey full swing abi na pure coincidence? Well…….me no sabi dat one o. But one thing wey sure for me be say the course dey high gear dis year. Maybe sha, the election weydey come sef get im own contribution to the matter. Na so we go dey see different different people weydey campaign for different positions. Dem go just stay there for gate dey wait for dem prey to come, make dem talk nonstop with sugar-coated promises. Na dem sabi o…

gist
The way porters sef dey welcome efribody inside the hall na another tori, “Hello sister, your I.D. card” “Call her back, show your card”. That one sef na anoda palava. The way dem come dey collect fine for Idiates ehn, e no funny at all. Na fine for dirty room ni, abina fine for I.D card ni, all sha join and Idiates no too like am at all. Leaving all dis matter, the painful thing be say (as una don sabi already), we come lose one fine sister of we own wey just get admission for our great skul. Una go dey wonder why I dey talk dis one but abeg I just want make una no forget our late sister for una prayers. Make we dey always remember her for prayers and make we too know say death fit knock on our door anytime. May God Almighty give her eternal rest. Amen.
Anoda tori wey hapin be say Aunty Lara, yes dat portar born one fine girl pikin on Saturday, make we jolificate wit am.
So……..mah people, till we meet again next week. Make una look forward to sweet sweet tori. Till then………

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *