IDIA GIST – fans

My people, how una dey? D weather nko? You sure say Naija no bi the headquarter of this global warming? But bad as e bi I know say e noh dey cramp your style too much. Our excos dem, e bi me like say dos babes bi prophetesses o, because their initiative to give us hand fans during registration don pass proactiveness. Those of us wey no get fans (I mean electric fans because as for human fans, dem dey breketeh, and you be nomba one oo).

A-blockites and B-blockites, dem na ma ‘weaknesses’ oo. Those hand fans don become accessory and asset to us. In case ma grammar dey burn your tongue, abeg no blame me oo, GES is to blame! LOL I no dey whine but true true I no mind if Idia turns 40 every session, reason bi say this global warming is not a joking stuffz.

One question wey I wan nahk una b say; na wen hand fan go handover to umbrellas. The overtime wey hand fan don do this year too much oo. Nawadays, every early mor mor, I go dey sing: “Open the flood gates of heaven, let it rain….” Soh tey even my alhaja room mates don turn back up, before I drop my first line they go join me dey sing: “Lord send the rain….” O ga for this weather oo!

queen idia

How acada? Hope your lectures no boring like my own? How other parols: Idia 101 and some of we country people wey dey borrow Zik 101. As you dey jack these elective courses noh forget the compulsory and required ones oo. Mak you sef dey remember say what UI has joined together, TSUNAMI can put asunder oo.

The main tori wey I wan nak una bi say this awa Idia Motto: “Live and let live” noh bi play play thing oo. Na so I hear say some people dey use their 6th room mate the play boji boji. As dem dey enjoy their cool game yawah just gass. Them noh know say this we country, wen you know person wey know person, people cannot mezz with you (in d voice of our bro, Falz).

Na so d rejected babe go call our ogbongeh mama wey dem dey call am Hall Warden. Our mama rake soh tey en carry the 6th roommate put for the bed space of her choice. She come talk say anybody wey mess up, she go transfer ram to Agbowo branch of Idia Hall. Na this transfer d oyibo people dey call ejection.

So my people, watin dey ground right now bi say mak we continue to receive and welcome roommates, boya 6th, 7th even to Nth roommates. Sake of say, the way wey we dey operate here na “Live and let live.” No forget say you suppose be your sister’s keeper, but I noh mean squatter ooo!

I noh wan stop but time no bi our friend!

Until next week, fwresh jist plus tori together with amebo go dey bulku bulku, yafu yafu and breketeh. Abeg no miss am oo. Make you noh you say I know tell you oo.

Queen Idia Press Organization like you weh weh!

Dem dey wish you better week wey good things go dey purshu you. Bye bye oo.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *