Una welcome my people. (In Jeniva’s foice) How’s you? How’s studies? Na me, CEO/MD and boss madam in charge of ‘Mebo Network Intanashonal.’ Ya welcome once again. I don bring una fresh mebo gist wey go totori your body. Hmmmmm, shey you know say plenty dey happen for inside this Idia sha. Wetin man no go see. Make I first start with the water condition wey fit kill pesin for inside here. Na so I go house Thursday, return Friday afternoon. As I come back my domot for A-block, na him my roomie dey tell me say I for sidon jejely for house; I think say she been dey joke. Time waka, na him I kon see dem Idia babes dey queue for that down down place wey dey beside flat. I even think say na pipe burst sha. Omo na dem babes dey find water o. Fear grip me. Even dem Iya Mayor no fit get water. The queue wey i see for that Friday alone na baba! No worry I go show you pishur. Dem Idia management sha help our condition small, dem carry tanker wey dey pump water come that A-block side. Me sef no fetch on top say i dey gather una gist. To cut my mebo short sha, dem bring light, water dey flow, dem Idia babes dey happy; even toilet happy say dem go flush am. (abeg, make we no enter that toilet gist)
EHNEHN! Una warden don vex. That love garden wey dey flat wey dem been abandon since last session; you don remember? She don dey progress work o. Na so I see say dem dey put stick for one corner for the field. I just dey laugh sha. Dem no go fit finish that work till I go komot for UI. In fact, when I come back come do clearance dem go still dey on top am. (lwkm o) No be curse, na true talk. I go show you pishur too.
Make I give you this last gist; gist too plenty i no fit download evetything now. As I dey go fellowship just this Sunday, na so I see our porters dey do wetin dem sabi do; fight with parent. Wetin happen? One mama park her car for gate front, na so madam ‘security’ go do her duties say make mama komot her car o. The mama no vex she repark for where go near the gate because say her pikin wan offload heavy keg. Na so madam security dey form boss madam (na only me be boss madam, any other one na counterfeit). She talk say she dey wait o, na so mama vex say she rude, say which kind package be that one na. Dem sha shout, spit different kind thing for mouth. Na him our famous porter wey dey carry lowcut come put mouth. Wetin she vomit vex me sef. I jsut dey observe before I see say I don late for fellowship. Our lowcut porter shaa dey yab mama say her wahala too plenty say she too get problem. Hmmmmm, this porter issue go cause problem one day o. The day yawa go gas on top say porter dey rude to parent ehn, I go wan dey there. You sabi say this same porter carry her craze reach my papa side sha. Gist for another day. Till I come ya way again, I remain una CEO/MD and boss madam of ‘Mebo Network Intanashonal.
Idia Gist
