EXCURSION
My pipu CG welcome una to another week and we also welcome all those who carry their kayak go excursion. We hope say una enjoy yourself for the place but I bin wan ask, na wetin una do for dia wey make president rish house come faint? Na wa oo. Anyhoos make una wey go soon become mama and papa let us know oo so we go dey save money wey we go use buy pampers and SMA GOLD.
HUMPTY STAR
Hehehe my pipu, the kain pipu wey we get for this our department ehn na God go help us o. E get this sister wey be course rep for 200 level. Dis sister too dey jump, she wan dey everywhere, do everything, she sha want make people dey see am. Na like that she dey do wey she come display her oversabi attitude for one of our Prof class. Na so dis our Prof tell am say her voice be like man own. Chai… as the prof talk am ehn na so everybori for class confam am sef. Sister biko go sit down we don see you, shebi na attention you want? Now wey you don get am shebi na to rest remain?
