SOMEBODY SHOUT ALLELUIA
Dis kind gist no suppoz pass wey we no go yan am. No be small smthing because for the past how many years wey awo hall get water tank dem neva wash am for once, na at last dem com decide to comot all the disease wey don dey make awo babes occupy the foam for jaja. Na the red cross people for UI helep dem disinfect and clean their tanks ooo. We even suppoz suspect the tank say e fit get small smthng of EBOLA…….shhhhh,no b me talk am ooooo.
DINNERISATION
Hmmmm, CG must yan dis one ooo,ah ahn why we go dey argue for congress about where we go do dinner? Which kind parole be dat one. Sotey som people dey suggest say make we do am in side school, some dey say outside. With the way the congress go, e be like say na for express or sky we go do the dinner. CG advice be say make una no play rough play oooo, since we no do dinner last session, e must to happen dis session for correct plaz.
YOU NO DEY TRY
Some people sef sabi fall dia hand and for dia mind dem think say na anoda person hand dem dey fall. Na so CG gather say e get one Press Editor wey no knw him function as e don tey reach for press. E dey believe say na to dey bring and edit article be him only work, e don forget say him function involve admin parole. My guy, CG dey advice you say make you better behave well and rep ur portfolio wella.
ABEG TEACH BETA
NA WA OO!!we don dey sixth week naw, and one we never do anyting for one departmental course wey we borrow, na lecture two we still dey. The thing wey he dey yan us be say “I wan gist I wan gist” abeg shey na gist we go write for exam? He still dey feel himself on top the dry jokes he dey crack.the thing wey vex me pass be say he dey hype him department pass anything so tey.he say other department na wash. Abeg shey na true say philosophy no dey bake bread? Say na so so suffer we dey suffer?