……………SHHH!!!!!!!!

Eyin Goons mi!!!..how una dey na? una go don miss me o? shoo, abi una don vex becos of last week tori? Abegii make una no vex oo, meanwhile make I nak una dis tori wey pass my ear. wonder no dey eva end ooo, this tori wey me wan yarn so make me open mouth like mumu as me sef hear am. Infact as I hear am, the thing wey comot from ma mout na diaris God oo.

I hear say two yeye boys wey dem dey stay for that hall wey share boundary with zoo. Nawa o, the tin sef heavy ma mout. Dis boys as dem go skool rish kom be finalist for that mata dem do wetin fit carry dem go kirikiri. Sha no be from ma mout una go hear say one of d yeye boys put him kini for the oda yeye boy mout. I wonder wetin lollipop dey do for mama Ngozi shop, banana finish for front of UI gate, see wetin u put for mout, nyama. Person whisper for ma ear say dem dey call am blowj*b abi wetin d person call am sef, I no tink say dis boys well oo, infact dem sick gan. Abi opeke don finish for UI ni.

Dis kain act wey dem commit na serious crime if dem land Agodi prison na say dem pardon dem oh, na offence wey fit carry dem go Alagbon prison for long. if I be judge na 35 years dem go use for prison with hard labour and serious prayer. Dem two go need ask Baba God for forgiveness bcos na only Baba God fit cure dem sickness.

Abegii make una no talk say ma own too much oh, but how u go take explain this case ooo? I dey waka pass senate building for night, naso I see one gal bendan dey face one of those white stone wey dey there. I slow make I see if she go stand up but I no see her stand up oooo, abi pipo don dey worship stone for UI?

Abegii me don dey comot ooo, bcos e no konsyn me, no forget say if them hear am for your mout, na OYO u dey oh.

Packer Eish

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *