PARROT TALK

 

Parrots_19477

You are my African queen, the girl of my dreams, you take me where I’ve never being, you make my heart go tingaling a ling.

  • It’s a new week again and I know you are wondering if parrot is in love, fortunately or unfortunately the matter no be as you think (Yoruba people they say butter no be monkey food); parrot is not in love yet so for those who want to forward their applications, it’s not too late but make una bear in mind say I no get six packs na just sharp mouth I get.
  • As he dey hot, parrot was at the wedding of a former member of The PAGE during the weekend, to say the wedding was dope is an understatement, from the beautiful cake to the swaggalicious dance steps of the couple not forgetting the mouthwatering kiss shared at the reception (abeg this part na strictly 18+, so if you be underage skip to the next line, make them no say na parrot corrupt you) but wetin pain me pass for the whole matter be say the officiating pastor skip the part of you may kiss the bride during the marriage rites, whether na mistake or na intentional, I know sabi but the thing still dey baffle me
  • The just concluded week witnessed the release of the first semester results of the current 300 level students and I hear say the thing get as he be, I even hear say person score 7 for stats, the one wey surprise me be the drastic drop in the number of first class students, anyways as things stand just keep on fighting and believe in yourselves, things can only get better but on a side note, I say welcome to the department of Agric Economics.
  • Whether this thing na true, whether na lie, I must to talk am, I dey hear say them catch two gays for zik hall, abeg zikites wey dey my class on behalf of our course mates wey be guys; are we safe???
  • This matter just funny to me, my 300 level colleagues for PAGE just dey always come up with somethings wey fit kill you with laugh, na for their mouth, I hear say if you collect meningitis injection you go dey dizzy, I no go too talk sha cos I dey eye one of them (there you have it, my confession)
  • My ears don hear things sha, na so I carry my two left legs go student affairs go check NYSC batch C list, as parrot jejely stand dey survey; some people dey rejoice, they organize how dem go travel together, in the midst of these, a lady who got posted to Katsina asked me if Katsina is in the North, I had no choice than to give her the ‘na only u waka come look’ because my friend wey dey there change from orange to black within the space of three weeks, my sister the Lord is your muscle.
  • Anybody wey sabi Farmer Palmer make he help me tell am say football no be hin calling, you need to see the way he kept wasting goalscoring chances during the training held on Friday, wetin dey vex me be say na their type dey abuse Torres. For Mr Ogundare, the less said, the better, the guy na my padi sha.
  • If I no talk this last one he go pain me gan, na the matter of the UCJ people wey dey score press boards within the university premises, na only God sabi the kind criteria wey dem use grade our board because that mark wey dem give us no reflect the kind hard work wey my crew dey put in. all the poor marks you people are sharing for The PAGE, there is Godu ooooooooooooooooooo.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *