Idia Gist

I don come again with ogbongeh gist wey una like to dey hear, no be style style ameboh na gist jare. How una week dey go? Hope una don settle down for school and work don start pereu as Yoruba people dey talk am. Break don finish o and new semester don start fast fast.
The gist wey dey happen now na campaign palava o, big time. He don tey whey I don reach quadrangle o, na so I come reach there for Thursday and everywhere be like say curtain dey the whole quadrangle. Na so for every angle, I dey see posters and banners everywhere like say something dey happen. Idia politicians, church posters, faculties and department posters kon fill everywhere as dem dey look for people wey go vote and attend programmes.
The thing kon get to the level wey I sidon for my room jejely when some people come dey knock as if say na dem pay for my room. With great humbility, I come stand up to ansa wey I dey think say na boo wey I go catch, me no know say na all this olodo politician. In Americana voice, he con say, “Is there a student of the Faculty of ……in your room?” I con vex finish say shey na campaign come make me standa from bed. Na so I just slam door with anger.
Another palava be say since the public address system in Idia kon dey work again, na so so announcement and instruction we dey hear and the thing dey disturb like die. Me sef I go go there one day go make announcement, I go talk my own.
The thing wey I go tell you be say make you dey very careful about porter matter make dem no put you for palava. Na so I hear say them catch somebody wey dey cook for room and the babe kon hide under the bed. Sha be very careful make them no catch you o.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *