CAMPUS GISTS

SUPER CONGRESS

Na so this our great department do congress on Friday o! CG no even sabi whether na congress abi something else wey the department do wey dem dey call am congress. Anyways, CG just wan advice say make all of us waka go back go do our thorough assignment on wetin congress mean. At least if no be for the purpose of this semester, make we just try for the sake of future generations, make outsiders stop this names wey them don dey call us since Friday!

 

MAMMY WATER

Sister! Na wa o! wetin we do you wey you just dey disturb our peace of mind with the hair of many colours wey you carry put for head? But na lie, we dey gidigba. Abeg! Just try small reduce this hair for your head, we know say you be fashionista, but when you come begin to dey constitute something else for people eyes, you suppose don know say time don reach to do sofrey o. So biko, repent!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *